Make dem talk

2Shotz

    Continúa después del anuncio

    Chorus
    Make dem talk
    Oun ton ri lobe, ton se waru owo
    Make dem talk
    Kulikuli poun kan odi naira kan
    Make dem talk
    We want to know wasup idi ti garri se won
    Make dem talk

    Verse 1
    My brother which kind nonsense be this
    The name Nigeria self dey backfire
    You no fit get common gari for five naira
    For poor man to chop now menhn omo I tire
    For junction na so, so sandi police dey collect
    Agbero don take style leave picking pocket
    Na so dem eye balls go deh shine for dem socket
    And if you no drop egunje for dem na heavy racket

    Oya my friend pack your car quick, quick
    Wey your license or your twenty naira roja
    I no deh send you if your papa na ex-soja
    Na my salary government dey use dey grease dem shoulder

    Na so i drop money for ten more policemen
    B4 I count ten, I drop everything I earn
    Even the small salary wey I get from Tribesmen
    Na only God go punish all of dem

    Continúa después del anuncio

    Repeat Chorus

    Verse 2
    Me and 2shot we wanna settle scores
    No need to rush all ye senators
    Egunje collectors, men in black against us
    Of course we gat the guts to burst
    Soja go, soja come
    Turn by turn won so doye idile
    Keran maje'le lasan lafi sole
    Our economy be like comedy
    Talent dey waste, no remedy
    See dem big belle, dem call am prosperity
    Bad man plenty pass ina we society
    49 sitting, 99 standing pack us like sanding,
    Ye, ye, yehi yeh

    Repeat Chorus

    Verse 3
    Second hand goods plenty now like pure water
    For oversea Naija be the gutter
    Lagos state don full with plenty omota
    See everywhere not one aje butter
    Everybody na sharp man, no slacking
    This man dey give the next man close marking
    Hijacking money na solo runs now
    Na which level dis economy dey go, I bow
    Serious issues go dey lie inside coffin
    If dem discuss am, na very often
    No gocking umunamu talking
    Coded tunes, 9ice and I run things

    Repeat Chorus

    Verse 4
    Make dem talk how is being run
    Seka koju ibon si rawa ni oti lo
    Ije teje tete emaje dagunro
    Don't be offended if your name is on the roll
    Kayin mu, kasufe, ikan loma gbele
    Nigeria must be great, loju olo'te
    Bawo lase mase, eja ka sowo po
    Ka le olote kafi'mo sokan
    Hausa to Igbo to Yoruba, hey!
    Kafi'mo sokan

    Repeat Chorus

    Información de la canción

    Composición: William Iroha y Abolore Adegbola Akande

    ¿Los datos están equivocados?

    Enviar revisión

    Canciones relacionadas