Mr. President

African China

    Continúa después del anuncio

    Verse 1
    Food e no dey
    Brother eh water no dey
    And our country no good o
    Everyday for thief, one day for owner eh
    Poor man wey thief maggi
    Omo, dem go show im face for crime fighter (crime fighter)
    Rich man wey thief money
    Omo, we no dey see their face for crime fighter
    Tell me something now rudeboy

    Rich man go dey halla prayer (modupe)
    Poor man go dey shout (anwuola m ei)
    Rich man go dey halla prayer (modupe)
    Poor man go dey shout (anwuola m ei)
    Make una lead us well
    No let this nation to fall inside well

    Chorus
    Mr. President [Lead us well]
    If you be governor [Govern us well]
    If you be senator [Senate am well]
    If you be police [Police well well, no dey take bribe]
    Oya lead us well [Nne me eh, Govern us well]
    If you be senator [Senate am well]
    If you be police [Police well well, no dey take bribe]

    Verse 2
    Fuel e no dey
    Brother eh transportation no dey
    And our road e no good o
    What about the NEPA people o
    we no get light
    Everybody just dey halla
    fuel no dey, na how we wan survive
    Many youth ready for work
    but as work no dey
    na how dey wan survive
    We be giant of Africa
    but to get visa enter Ghana
    na WAEC [oh my God]
    Policeman go see white
    e go tell you say
    I say that thing na red
    Tell me something my people
    Make una lead us well,
    no let this nation to fall inside well

    Repeat Chorus

    Continúa después del anuncio

    Verse 3
    Alhaji wey pull Khaki
    say the name of him party
    People Destroying People
    Na the name of the party
    election for my country
    na paddy paddy
    wayo wayo
    arrange no ni
    People wey vote them in
    still dey live in pain
    This na disgrace
    I am so ashamed
    We don collect shop permit
    Collect trading permit
    trading permit
    You still dey burn shop
    You wan tell me say
    you no know when them pay
    Why you dey make us
    dey live in pain
    Make una lead us well
    no let this nation to fall inside well

    Repeat Chorus

    Omo nothing dey par
    Anything wey par na witch
    Na im make we dey say
    Omo no lele
    Tanke (echo)

    Repeat Verse 1

    Repeat Chorus

    Repeat Verse 2

    Baba God help this country

    Repeat Chorus till fade

    Información de la canción

    Composición: Chinagorom Onuoha

    ¿Los datos están equivocados?

    Enviar revisión