NEPA

Chiido

    Continúa después del anuncio

    Verse 1
    Nepa, na lie you don start again, every night around 8pm
    I don pay my last bill with the money i suppose
    Go use buy garri for my sunday night meal
    See me no money to buy some kerosine
    No battery for my touch light
    I dey go malaam for credit
    Aboki won use im horse whip
    Trash me for back i con run go the streets ehh
    Okada man wait, abeg stop make you carry me go mushin
    I dey go nepa office
    Me and them go fight today
    I dey vex like that pikin don pour me pepper spray
    God help them if dem never bring my light by the time i con reach my house
    When you watch football [dem take light]
    Thriller [dem take light]
    Comedy [dem take light]
    Music [dem take light]

    Chorus 4x
    Nepa bring back my light bring back my light
    I don tire o

    Verse 2
    I don reach nepa office
    For desk receptionist jus they give me long tory
    Where the man in charge chei una they find serious trouble
    Abi you don forget say me i dey hussle as i dey now
    Hunger they wire me
    Sote i fit eat a horse that one na metaphor
    Jokes apart biko wey my light
    I go scatter the paper for your table
    I dey talk you, ma dey sit their dey watch cable
    My situation dey very unstable, oga you dey hear me so
    Oh boy, shutup abi na only your light wey nepa take
    If i land you one you gon shake like olumorock
    Wey king kong scatter, you dey think say because i dey skinny
    I no go fit batter
    You and your colleagues na thief una be, ole barawo
    You don fap my light fee wey my light

    Continúa después del anuncio

    Repeat Chorus

    Verse 3 [Ay]
    Na any time nepa fit touch light
    Reason people hold on to touch light
    Wahala start wen i start to touch light
    Food money dem go take am buy candles
    People carry lantern and okada carry bike handles
    Candle wax plenty on top table
    Like channel on top cable
    Darkness nepa na clothes and liod in turn tables
    Dem dey make people uncomfortable
    Na waa i dey here dey form syllables
    And rap about light, electricity na part of our lives
    Situation still dey highlight
    Facts about light
    When light come people be like up nepa when dem mean
    Frock nepa cause dey take light and leave hot tempers in block letters
    You no fit dey your room like penpals
    Generator necessary inside house like ink in pen pal

    Repeat Chorus 4x

    Información de la canción

    Composición: Chinedum Nnochiri

    ¿Los datos están equivocados?

    Enviar revisión

    Canciones relacionadas