Roforofo Fight

Fela Kuti

    Continues after the ad

    Roforofo fight...
    From Abeokuta city
    Translation to original English:
    She tear pata, he tear buba
    She tear pata, he tear buba
    She tear trouser, he tear pant
    She tear trouser, he tear pant
    She pull the thing commot, he tear the thing
    She pull the thing commot, he tear the thing
    All don scatter
    From Abeokuta city

    Get away
    Fuck off
    Who are you?
    Go and die

    Fuck away
    Get away
    Who are you?
    Go and shit

    You dey craze
    I no craze
    Fuck away
    Who are you, eh?

    Na two people dey yab so
    Na two people dey yab so
    Where them dey yab, roforofo dey
    Where them dey yab, roforofo dey

    Now listen to me now now

    Continues after the ad

    [Chorus]
    Huh!

    Two people dey yab
    Crowd dey look
    Roforofo dey
    Two people dey yab
    Crowd dey look
    Roforofo dey
    Wetin you go see?
    Roforofo fight eh
    Wetin you go hear?
    Roforofo fight eh

    If you dey among the crowd wey dey look
    If you yourself
    You yourself dey among the crowd wey dey look
    And your friend
    Your friend dey among the two wey dey yab

    Tell am, tell am, tell am, tell am
    Tell am make him no fight o
    Make him no fight
    Make him no fight because Roforofo dey
    Your friend him don vex
    Him don vex patapata, him no go hear
    Your friend him don vex
    Him don vex patapata, him no go hear

    By and by
    By and by the fight go start
    By and by
    By and by them go fall for roforofo o

    Them face go be roforofo face
    Them yansh go be roforofo yansh
    Them body go be roforofo body
    You no go know
    You no go know who your friend be
    You no go fit help your friend
    Just because roforofo dey

    If you wan help your friend
    Roforofo go rub for your face
    If you wan help your friend
    Roforofo go rub for your yansh
    You go tell am make him no vex
    You don tell am before make him no fight o
    Make him no fight
    Make him no fight because roforofo dey

    Now listen to me now now now now

    [Chorus]
    Huh!

    Roforofo don change them
    Them go look like twins
    You no go know who be who
    Roforofo don change them
    Them go look like twins
    You no go know who be who
    You no go know your friend from who
    You don tell am before
    Make him no fight o
    Roforofo dey for there

    Two people dey yab
    Crowd dey look
    Roforofo dey
    Wetin you go see?
    Roforofo fight eh
    Wetin you go hear?
    Roforofo fight eh

    Song details

    Composition: Tony Allen

    Did you see an error?

    Enviar revisão