Lost Heart

kayroz

    Continúa después del anuncio

    Yeah
    I don see pain, I don see wahala
    But God still hold me steady
    I cry for nights wey nobody know
    Smile for day, but my heart dey slow

    Love turn scar, e still dey show
    Trust my soul I no dey sure
    I give my all, I no hold back
    Dem play my heart like soundtrack

    Every promise dem talk na cap
    I fall so deep, I lost my track
    Now I dey talk to God in silence
    All my tears turn to reliance

    If peace na price for my patience
    I go wait, no more violence
    I dey heal, I dey breathe again
    God dey fix wetin love don bend

    If love come back, I pray e clean
    'Cause I no fit break, I no fit bend
    I dey heal, I dey find my way
    Heart don rest, soul don stay

    If you be love, come pure, no games
    I no wan break again
    I learn say love no be rush
    If e no dey calm me, e no be us

    Continúa después del anuncio

    I choose peace over touch
    Soft heart still need strong trust
    Now I dey move with prayer first
    Before my heart go invest

    If e no dey real, make e rest
    I no dey do pain remix next
    I give my wounds to Jehovah
    Make e wash my soul with water

    If person come, make e proper
    I don tire for another chapter
    I dey heal, I dey breathe again
    God dey fix wetin love don bend

    If love come back, I pray e clean
    'Cause I no fit break, I no fit bend
    I dey heal, I dey find my way
    Heart don rest, soul don stay

    If you be love, come pure, no games
    I no wan break again
    If you see me smile, e cost me pain
    If you see my peace, na grace remain

    I talk to God, I call am name
    Say guide my heart, protect my lane
    No more sleepless nights go last
    No more fake love in disguise

    If you no dey real, pass me by
    I choose God, I choose life
    I dey heal I dey strong again
    From broken pieces to better man

    If love return, make e understand
    One more break I no fit stand
    I dey heal, I dey trust my prayer
    God dey lead me everywhere

    If na love, make e fair and clear
    I no wan break again
    Yeah
    Peace over pain
    God over everything

    Información de la canción

    Composición:

    ¿Los datos están equivocados?

    Enviar revisión